How Canada New Restrictions on Study and Work Permit Go Affect International Students

Canadian goment don annonce new restrictions on work and study permit for international students wey wan undergo postgraduates studies as dem plan to reduce di number of dia annual students intake.

Marc Mille, Canadian Immigration Minister announce on Monday say dem wan reduce di number of international students for dia kontri by 35 per cent in di next two years.

A couple holds the flag of Canada.

Di minister note say dem go allocate di numbers of international students base on di population of each province so international students go fit progress wit dia studies in di kontri.

Di minister also announce say dem go stop to issue work permit to international students wey graduate from Public College-Private Partnerships programs.

“In order to maintain sustainable level of temporary residence for Canada, as well to ensure say no further growth in di number of international students for Canada for 2024, we dey set national application intake cap for a period of two years for 2024.

“Di cap dey expected to result in approximately 364,000 approve study permits, a decrease of 35 per cent from 2023,” im tok.

Di minister maintain say open work permit go only dey available to spouses of students on masters and doctoral programs as well as professional program, such as medicine and law.

E add say spouses of international students wey dey undergo undergraduates and college programs no go dey eligible.

“In di coming week, we go announce say open work permit go dey available for spouses of international students on masters and doctoral programs as well as professional programs such as medicine and law,” di immigration minister tok.

“Spouses of international students wey dey under go undergraduates and college programs no go dey eligible.”

Three key measures wey Canadian goment wan implement for 2024 international students

On monday, di minister list out three measures wey di goment wan implement for 2024.

  • Reduce study permit for international students by 35%, wey go be approximately 364,000 study permits across all province based on dia current population.
  • Starting from 1 September, Canada go stop postgraduate work permits for graduates of Public College-Private Partnerships programs.
  • Also, open work permits no go dey available to spouses of students on undergraduates and college programs - na only spouses of masters and doctoral programs, as well as professional programs such as medicine and law go dey eligible.

Oga Miller explain say dis measures no go affect international students wey don get study permit so dem go fit finish dia programs.

E tok say dis temporary measures go dey in place for two years and di Canadian goment go reassess new application for 2025 by di end of di year.

"Dis temporary measure go dey in place for two years and di number of new study permit application we go accept for 2025 go dey reassessed at di end of dis year," e tok.

According to di immigration minister, Canadian goment stance no dey against international students but dem wan ensure say as students dey arrive for di kontri dem dey receive quality education.

“We wan ensure say as students dey arrive for Canada dem receive di quality of education dem go sign up for, e go be dis service to welcome international students for Canada wen we know say no be all of dem go get resources to succeed for canada and dem go dey disappointed in Canada educational system wen dem return to dia home kontris,” Oga Miller tok.

Di minister tok say di province of Ontario wey get di highest number of international students go see 50 per cent reduction in international students intake next year.

Dis new restriction go affect Canadian colleges and universities wey dey rely on school fees of international students for revenue.

Between 2012 to 2022, international students for Canada increase by 193%, according to data released by Canada immigration ministry.

Dis figures don contribute to increased prices of housing for pipo.

Di Canada Mortgage and Housing Corporation - one national housing agency - estimate say di kontri go need 3.5 million more housing units by 2030 to restore affordability.

Source: BBC

Comments

Popular posts from this blog

A Guide to Canadian Immigration Pathways for Health Service Support Workers

IRCC Introduces Two New Immigration Pilots for Rural and French-Minority Communities

Canada Invites Immigration Candidates in General Express Entry Draw